+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Russian Govimet Travel To Anoda Africa Kontri To Form Padi

Sergey Lavrov don go visit di kontri of Guinea on Monday on behalf of he kontri Russia to form padi with dem.

Lavrov na di Foreign Minister of Russia and na di Foreign Minister of Guinea, Morissanda Kouyaté, nai welcome am so that dem go discuss how to fit corporate to make tins beta for Guinea.

Since 2021 nai military start to dey rule for Guinea afta Col. Mamadi Doumbouya take power from civilian say di president dey wan cus confusion for di kontri with the way he dey tok and nor dey keep to promises.

As Lavror don go visit Guinea, e just dey show how Russian govimet dey enta all di West Africa kontri wey military don take over like dem Burkina Faso, Mali and Niger.

Di Russian Foreign Minister still travel from Guinea go Congo Brazzaville to meet President Denis Sassou N’Guesso.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM