Honourable Chief Shimite Bello, wey everybodi dey call Madam Sabificate, di Special Adviser to Govinor Sheriff Oborevwori for mata wey concern Trade and Export, nai dem say don die on Easter Sunday cus of di way her husband dey maltreat her for haux.
Bor be small shock nai full pipo bodi as dem hear say Sabificate don die of posion as many dey say dem dey suspect say sumtin dey behind am.
Wetin di Family tok be say dem suspect di husband Pastor David Favour Love say nai he poison Sabificate as bifor dem rush her to hospital she dey foam from mouth but as dem reach St. Luke’s Hospital for Asaba, na there she die.
As she die nai police arrest di husband as many pipo still dey say dem never believe say Sabificate don die cus na woman wey dey give pipo joy anywhere she enta and even micro and small business pipo for Delta State nor dey happy.