Senator Ireti Kingibe, wey dey represent FCT pipo for Abuja don say wetin Senator Natasha Akpoti-Uduaghan do dey cus trouble for where to sitdon for di National Assembly no suppose be like dat.
Everybodi shock di way dem see Senator Natasha stand face to face with Senate President, Godswill Akpabio, dey shout for am say she nor go ever change her seat.
Afta di many tok and Natasha come show for Arise TV morning program on Friday, say di resin way nakd Senators Akpabio change her seat na cus he nor dey like make she tok for di House and he do bin beg her to friend am two times but she nor gree.
Natasha don tok komot nai Senator Kingibe of FCT say she blame Natasha as she nor suppose do like that cus dem change other pipo seat too so she for use sense handle di mata as all of dem know say di House nor dey favour women.
She say dem know say Senate nor dey behave well to women, di oda teree woman senators nor wan tok anytin as dem nor want any bad energy from Natasha.