Senate and dem national assembly don laslas pass di new minimum wage wey Presido Bola Tinubu peg for ₦70,000
Na on Tuesday nai dem bill sharply pass di first, second and third reading.
As dem pass di new minimum wage, Senate don still look into di years wey dem go dey change di bill say e nor go be force years again but now teree years
Di aim na to make sure say Nigerian workers get better working environment to work.