+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Senate President Show Koret Line Of National Anthem

Senator Godswill Akpabio say make National Orientation Agency know say di line if di National Anthem wey dem bring come back, nor be wetin Senate approve dem dey show Nigerians.

Wey dem dey do dem plenary meeting, afta dem come back from break come decide to go for adjournment till July 2 na there Akpabio say make dem sing di anthem again.

As dem dey sing di anthem naso Senate President dey look di book to know di right line.

As dem recite di anthem finish nai Senate President tell di lawmakers say make dem nor folow di one wey NOA give cus dem use wrong word like Nigerians all and proud to say, instead of Nigerians all are proud to say.

He still say di part of ‘though’ tribes and tongues may differ, nai be di right one instead of di ‘those’ tribe and tongues wey NOA put.

While for di part of Nigerian may be blessed di koret one na ‘Nigeria shall be blessed’, cus na must say di kontri must beta.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM