+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Senegal Don Start To Produce Oil and Gas

Senegal don make dem own history part for oil and gas as di West Africa kontri don start to produce oil di very first time on Tuesday.

Na for Deep water of Sangomar nai dem go use produce 100,000 barrels of oil per day and di water still even get gas.

With dis new development for Senegal dem believe say na billions di kontri don enta like dis cus even President Bassirou Diomaye Faye don promise say hin go manage di kontri moni very well.

Di company wey handle di project Woodside, one Australian oil production company tok say na big history nai don hapun for Senegal as dem start production on Tuesday.

Wey di President dey even tok to students on Tuesday nai he tell dem say make dem nor worry dat all di moni wey go come out from di oil and gas production he go manage am well so dat dem wey dey now and their future children go chop and enjoy from am.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM