+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Senegal President, Faye Meet With Nigeria President

President to Senegal Faye Bassirou reach do presidential villa for FCT Abuja to meet and sitdon with President Bola Tinubu.

Na di first time wey Faye dey travel come Nigeria afta he don be president and naso Presido Bola Tinubu say na beta waka hin do so cus many young pipo for African dey look up to am.

As Tinubu dey welcome di 44yrs Faye, nai he come tell am say he go beta make dem join hand fight terrorism, who dey tiff pipo to go do ashawo work or labor work, poverty and other bad tins cus na only like dat dem fit dey united for di region.

President come say Senegal don prove am to di world say democracy still good and even as di relationship between Senegal and Nigeria don dey like bread and butter for years now, dem get to work togeda to keep am.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM