+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Shine Eye Fake Sugar Dey Market oo, FCCPC Beg Nigerians

Federal Competition and Consumer Protection Commission, don dey shout ring bell make pipo nor buy fake sugar wey nor even get vitamin A cus of cheparticle wey dem see for market.

Dem say that vitamin A wey dey normally dey sugar dey epp for eyes, bodi, for children and even pesin wey get belle need am but dis one wey dis fake product dey waka for market dem get cut di wings.

From Brazil nai di Commission say dem take dey import so sugar from and e nor even get name, no batch nuba, expirey date and di normal tins wey pesin fit take check.

Nai FCCPC Director of Corporate Affairs, Ondaje Ijagwu say wey dem hear of di sugar, dem come hide enta market to know only to see sat di tin full South-West and North-East markets for di kontri.

Buy he sha say, make pipo nor fear as dem dey work with NAFDAC to make sure say dem komot di whole fake sugar from market according to di guideline of NAFDAC.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM