+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Short Skirt Fight Between Husband and Wife Lead To Death For Adamawa

One Mr Patrick John wey dey stay for Faram Faram village, Fufore LGA wey dey inside Adamawa State don die afta he fight with him wife cus she dey wear short skirt for house.

According to tori na forJune 13 nai Patrick come back from drinking palor see say he wife, Maryam wear short skirt tanda for house.

As di husband see di skirt he head wan blow cus he don dey warn di wife make she nor dey wear short skirt again as he nor like am.

Bifor you know, argument don start wey come lead Patrick to tie neck Maryam wey get belle. She come dey shout for neighbors to find epp her, bifor dem run come free her from her husband.

Dem don separate fight finish, small time nai Patrick come back to beat Maryam again, as di woman see say she get epp hersef nai she karey hoe release am for di husband head.

Patrick reach hospital for treatment but na the wound come laslas kill am.

Wey di Chief Magistrate Court 2 for Yola, Magistrate Musa Alhaji Adamu, come dey judge di case of di woman, nai she say she really do am but na just to save hersef.

Court come postpone di days karey am to July 10 but say make di pregnant woman still dey for prison.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM