No be small sumtin nai di Lagos University Teaching Hospital, LUTH, don do to give hope to pipo wey get sickle cell disease afta one bone marrow transplant wey dem do for two patient wey get di disease.
Di two na one mature pesin and anoda one wey be children dokitor nai dem bin admit did di Sickle Cell Foundation, Marrow Transplant Center for Lagos.
Di tin wey dis transplant don do for di pipo life nor be small as na even beta name don gum Nigeria for West Africa side to fit do dis kind operation.
Two of di patient don go house but di hospital still dey observe dem and as e be, na like 127 pipo nai dem wait for di Sickle Cell Foundation of Nigeria, SCFN, wey colabo with LUTH to make sure say pipo wey get di sickness fit come out well again.