+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Singer Onyeka Onwenu Don Die For Lagos

In year 1952 for Obosi, Anambra State nai pipo start to happy cus dem born girl pikin, Onyeka Onwenu, wey grow start to sing and even reign with ‘For the Love of You,’ but for 2024 nai she die.

Gist say, Onwenu go one biday party for go sing for Banana Island for Lagos, as she sing finish waka go her seat to sitdon, she never put nyash for seat finish, naso di singer fall fo ground nai pipo rush her go hospital.

Na birthday party of Stella Okoli di owner of Emzor Pharmaceuticals company celebration nai Onwenu go but she nor know say on Tuesday nite she go die.

Dem rush her to Reddington Hospital na for there dokitors take confam say she don really die. Di family go soon tok about her death.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM