+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Skit Maker Bury Sef Inside Coffin For 1 Day To Show…

One guy wey dey do skit for social media, Young C,  just sitdon tell hin followers say hin go like bury hinsef for 24hrs inside ground.

On Wednesday nai di guy karey tins for di journey to di land of grave. Even he Tiktok handle sef dem don band am cus he dey do life streaming and join sef for he YouTube channel.

Wey Young C wan enta inside di grave he karey pillow, bedsheet, water, power bank camera and two bulb lite.

Bifor he pipo come dig am come out on Thursday he don dey show say he tire but still dey push on.

For one of di update wey hin put online he say di water wey he dey drink don dey finish and if he finish bad as he be, maybe na hin own piss he go drink.

Wey dem finally dig am out from di woden coffin on Thursday, di skit maker tore but he come still dey tell pipo make dem nor try wetin he do cus e dey very dangerous.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM