Hadiza Jamilu, 18 years housewife for Yobe State, nai life don be say she fit use prison as her free accommodation afta police arresr her cus she go cut her husband manhood wey dem dey fight.
Na on Friday na police say dem just get one kind call from Potiskum LGA, where di husband and wife dey stay but as dem reach there wetin dem eye see na anoda tin as di man dey swim inside he own blood.
Naso dem rush di man to di first clinic but di clinic say di work big pass dem nai dem karey di man to Azare Medical Center, meanwhile di wife run afta she cut di man gbola finish.
On Monday, February 9, nai police trace di young wife for where she dey hide catch her, she never give resin wey make she cut di man johnthomas komot but police still arrest her.
Even di husband never fit tok well cus of di pain wey he dey pass, but only point di wife say na she cut he gbola. Tokpesin of Yobe Command, Dungus Abdulkarim, say investigation still dey on and dem go give details weda di man fir use di gbola again.
