+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Sojas Don Go Scatter Okuama Community Again

Sojas don karey demsef go Okuama community wey dey for Ughelli South LGA, and dis time na gbasgbos in anoda style nai dem unleash.

Wetin dey come from di community now be say na early morning today Monday nai sojas just karey demsef afta dem don leave dem gunboats for Okoloba community, come waka with leg enta Okuama start to shoot any pesin wey dem eye see.

One man from di village say few weeks back nai dem arrest some of di community leaders bifor dem know on Sunday yesterday, nai di village pipo see drone dey fly for di village, come reach Monday morning sojas don land dey shoot dem again.

Di man wey dey tell tori pipo come even send di video of di drones, say na bush him dey and he still dey find he pikin. Come dey beg govimet make dem come epp dem cus even di house wey don manage build sojas don come scatter am again.

Di time wey dis tori dey come out no bodi don know di real resin wey make sojas come dey go shoot again for Okuama.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM