+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Strike Don Off Lite, Senate Dey Beg Labour Union

Organized Labour don start dem strike say na di only language wey Federal Govimet go hear about di new national minimum wage wey dem dey shout say make dem increase for workers cus everytin don dear for di kontri.

Dis early mormor nai report come say Transmission Company of Nigeria wey dey under di union don off lite for di whole kontri.

Federal govimet bin don tell Labour say make dem nor go strike now cus e nor go good for di economy.

For meeting wey govimet send Senate President Godswill Akpabio and House of Rep oga make dem go tok with Labour Union, na there dem take dey beg say even dem na members of Labour.

Di Speaker say he understand say di toking process dey very slow but make di Organized Labour still consider wetin dem wan do cus e nor go make sense for di knotri.

Remeber say FG don stamp di new minimum wage for N60K but NLC President, Joe Ajearo and Festus Osifo of TUC say workers nor go fit kolet that kind moni expect N494,000.

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM