Supreme Court don troway di case wey Govinor, Siminalayi Fubara bring to comot 27 members of di State House of Assembly cus dem comot from PDP go join APC.
Di Court wey Justice Musa Uwani-Aba-Aji judge on Monday nai tell Fubara lawyer, Yusug Ali, SAN, say make dem go sitdon one side.
Na Govinor Fubara nai first say he nor want di case again bifor di teree man panel cus water don swelup for di case and even di Rivers State House of Assembly and di Speaker, Martin Amaewhule, wey dem lawyer Chief Wole Olanipekun SAN represent dem gree.
As all parties involve for di case gree to karey mata from court naso court say make Fubara pay 4million naira to di House of Assembly and Amaewhule.