Wahala don deu smell near di tax reform law even bifor January 1st go start cus wetin National Assembly pass nor be wetin come out to public.
Everybodi don dey call make dem stop di tax reform cus tok say wetin President Bola Tinubu sign dey totally different from wetin di National Assembly sitdon read and say e dey okay for Nigerians.
On Wednesday, Abdulsammad Duski, one PDP lawmaker from Sokoto, nai first bring di mata up say dem dey sitdin and water dey pass bridge, say di four version of di tax bills wey dem sign for June 2025 na entirely different from wetin President sign and wetin public dey see.
Cus of dis, di Speaker of di House of Representatives, Tajudeen Abbas, don set 7-man ad hoc committee make dem investigate di mata to really know wetin hapun for wetin dem sign and di one wey PresidentTinubu sign.
