E never reach how many days wey terrorists go kidnap 25 girls for skool inside Kebbi State, now today Friday dem don karey demsef go St. Mary’s Catholic Skool wey dey for Papiri community, Agwara LGA for Niger State, tiff many pipo.
As e dey now, dem never know di nuba of students and teachers wey di terrorists kidnap.
Wetin one insider tell tori pipo be say dem still dey put di names of di students togeda and na di Church go bring out official statement.
As e dey now, police command for Niger State never tok anytin about di kidnap.
