Nigeria Police Force say dem dey find one of dem official motor wey lost from dem headkwata for Abuja in July 28.
No be small shame nai rub for police face as dem say dem nor know how tiff take enta dem park tiff one of dem motor, now di Force Criminal Investigation Department (FCID) don karey di case for head, tell all divisional police officers, area commands for di kontri say make dem shine eye to know di whereabout of di motor.
According to insider di motor wey dey lost na Toyota Land Cruiser with registration nuba NPF 5594 D and na Department of Operations for di Force Headkwata Louis Edet House, Abuja nai bin dey use.
Police sha don tell other security operatives make dem epp look for di motor or bring any information come give dem.