+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Tinubu Don Cancel South Africa Trip Cus Of Attack For CAC, Kebbi

Afta di evil wey bandits terrorists do for CAC for Eruku town wey dey Ekiti LGA, Kwara State, and di kidnap wey still hapun for Kebbi State, President Bola Ahmed Tinubu don say he nor go travel go South Africa and Angola again.

Na today Wednesday nai president don pack he bag to go bifor but he come stop, send as VP, Kashim Shettima make he go see wetin hapun for Kwara State, while 20th G20 Summit of Leaders for Johannesburg, South Africa, and later fly go di 7th AU-EU Summit for Luanda, Angola, nor go work again.

Na President Tinubu Special Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga, nai announce di new move with statement on Wednesday for Abuja, say Presido dey wait for security mouth for di kidnap pipo and how dem gi save dem.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM