+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Tinubu Never Do Any Public Tok Again Since On Sunday – Onanuga

Tok your own make I tok my own na wetin dey hapun for President Bola Tinubu aides cus of video wey dem post about Presido dey tell Nigeria say tins go soon dey okay.

Na on Wednesday evening dem post di video for Tinubu Instagram and X hakant as he dey tell pipo make dem use di suffa take rub pancake cus very soon Nigeria go come out and nor bodi go remember di bad days again.

But later for nite nai Tinubu Special Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga, come tok different tin about di video.

As he say di last time wey Presido tok na on Sunday broadcast and dis video wey dey waka upandan na old sumtin of last year.

Even sef, pipo for social media don dey wonder which kind confusion dey do di aides as O’tega Ogra, di Senior Special Assistant to Tinubu, don bin post di video too say Presido deg beg Nigerians.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM