+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Tok Don Make Katsina Govimet Give Resin Why Dem Wan Free 70 Bandits

Tok full ground with di plan wey Katsina State Govimet get to free more than 70 pipo wey dem hand link to bandit, as pipo say di plan nor go work.

Di tori bust out afta letter wey di state govomet write on January 2 to di Administration of Criminal Justice Monitoring Committee, ACJMC, come outside.

For di secret letter di govinor dey tell di Chief Judge of di state, make he use Section 371(2) of di Administration of Criminal Justice Law for Katsina wey dem do for 2021 take free di bandits.

Say di resin na to bring orace for di state but oda pipo from group, families wey don suffa from bandits hand say na lie e nor go work cus na just way to make tins worst.

Even with di shout wey pipo dey cry, di state Commissioner for Internal Security and Home Affairs, Nasir Muazu, dey tok for DCL Hausa say di policy nor be bad tin cus oda kontris dey do am too, all to make peace reign.

He say for places like Safana, Kurfi, Sabuwa, Faskari, Danmusa, Bakori, Musawa, Matazu, and Dutsinma, cus of dis accord , pipo wey bandits tiff for dat side don get freedom, so if pipo lpok am deep dem go see di positive side.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM