+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Tomorrow June 12 Go Be Public Holiday – FG

To mark dis year 2024 democracy day wey go be tomorrow June 12, Federal Govimet don say na public holiday dem go use celebrate am.

Na di Minister of Interior, Hon. Dr. Olubunmi Tunji-Ojo nai tok for statement wey di Permanent Secretary of di ministry, Aishetu Gogo Ndayakon, sign, say make Nigeria keep demsef togeda and nor forget di struggle of di founding fathers.

Tunji-Ojo come still tok how President Tinubu mind dey to see di kontri prosper how tin goes fit beta for di economy and security side.

Dem dey call all Nigeria pipo to look and see bright future as di nation dey mark anoda democracy day.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM