+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Too much Kepeme For Gaza As Israel Attack Kwatinue

Pipo just dey die like crayfish for di war between Israel and Gaza as di latest be say na 68 pesin done due with 77 wey wound for di attack wey Israel military give West Bank for Gaza.

Two days nai Israeli military don tanda take over Tulkarem and Nur Shams according to wetin authorities tok.

Some pipo die for Jenin governorate, Tulkarem governorate, and Tubas governorate.

No be small pipo nai wound for di raid and di fight sef and Many attack don make UN World Food Programme (WFP) say make dem workers nor dey waka for Gaza again cus e don pass 10 times wey Israeli gunfire touch dem UN motor in duty work.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM