+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Tripartite Committee Sharply Tok Wetin FG Fit Pay Labour Today, President Tinubu

To ensure say everytin dey okay for di kontri concerning minimum wage, President Bola Tinubu don tell di pipo wey go epp am tok with Labour make dem come up with price wey govimet go fit pay today.

As President dey tell Minister of Finance and Coordinating Minister of the Economy, Mr Wale Edun, say make dem sharply bring di figure wey dem wan pay so that all di crisis go laslas stop.

Yesterday nai di tripartite committee wey be Wale Edun, the Minister of Budget and National Planning, Atiku Bagudu; Minister of State for Labour and Employment, Nkeiruka Onyejeocha; Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris; and GMD/CEO, of di Nigeria National Petroleum Company Limited, CEO, NNPCL, Mele Kyari, take go meet President dey tell am how dem waka pass.

Wale Edun say di tin dey pepper govimet bodi as workers never dey enjoy and dem want make tins go well for pipo nai be dis everyday meeting.

Remeber say afta many tok wey FG don bin do with Organized Labour na N60k nai dem gum bodi put but as Labour hear di amount na so dem dodge am like stray bullet.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM