Wey some international group dey say di way Senegal lawmakers take put very strong bad law against pipo wey dey do man to man and woman to woman relationship for di kontri nor good but di Senegalese stand say na wetin dem want be dat and who nor like am fit use head jam wall.
Bifor di President Bassirou Diomaye Faye with di Prime Minister, Ousmane Sonko karey di mata make lawmakers resin am, dem don catch come pipol go put for jail.
Na 135 MPs for Senegal parliament nai gri say di law wey dey bifor nor hard reach dem come top am to 10 years for prison for any pesin wey dey do gay or dey support gay.
Di only tin wey remain now na to send di bill to President Diomaye Faye make he sign am to law.
