+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Two Pipo Die Again For Kenya Protest

Di protest wey dey go on for Kenya don dey disturb di East Africa kontri cus many of dem don say make President William Ruto’s resignation.

One of di youth wey folow for di protest, Norbert Mwalo say dem know say Govimet na for di pipo but di way di tin dey go now na youth govimet nai dem want cus President William Ruto na just figure head hin be.

Just two years for office and Ruto don dey face dis kind kasala even though say di high tax wey dey cus di problem he don abandon am on Wednesday but di kontri pipo say dem nor get trust for am again, make he komot from di position.

Two pipo again die on Thursday afta clash hapun between protest pipo and police. Dem even burn one side of di parliament building for all dis crisis problem.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM