+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Uganda Youth Wey Protest, Land For Police and Court Room

Youths for Uganda don folow dem broda step for Kenya as di East Africa kontri say dem must folow GenZ way and do protest too.

Uganda still start dem own online dey provoke say dem must chase out bad govimet and politicians wey nor dey do well.

But on Tuesday many of dem wey come out for di anti rallies for Kampala nai police arrest and some don even dey wait to go court.

President Yoweri Museveni, don bin ban say make di youths nor do protest cus any pesin wey try am just dey play with fire.

Lawyers way even dey rep some of di protest pipo say dem pass 60 wey dey with police plus TV and radio presenter and teree young leaders , but dem dey for court and di court say dem be common nuisance wey dey disturb di kontri peace.

Bifor now di police tokpesin, Kituuma Rusoke, don bin send to block roads and even di one to di parliament side cus make no bodi spoil di peace of di knotri.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM