Ugborikoko skool don para follow di Senior Prefect of 2000 set, Mr Peterson Ebialade Okpomu, wey be dem president as he gi chop N914,000 charity moni wey dem bin wan use take do work for di skool dis December.
Di investigation wey di Disciplinary Committee do show say Okpomu karey di association check, come go lie to di Treasurer, Ms. Oke Dick Kandy, say make she sign blank cheque for moni wey di group wan take do business only for am to karey di moni use for business wey fall.
Wey di committee tell Mr. Okpomu wetin he do, he gree say he nor suppose karey di check and even use di group moni put for business, he promise to pay but till now dem never see any payment.
As all di date wey dem give di president don fail di group say dem don ban Okpomu not to hild any position, Due to his failure to meet the deadlines, Okpomu has been removed from office, and he must pay back di moni. Wey tori pipo call Okpomu for di mata, he nor gree say anytin.
