Wetin US Congress tok say make dem ban visa and freeze di property of pipo wey dey cus religious gbege for Nigeria and 8 pesin name don dey di list.
US list dem say dem get connections with Boko Haram and Islamic State of Iraq and the Levant nai make dem freeze di hakants.
Dem names dey for di United State Treasury’s Office of Foreign Assets Control join with odas wey dey do wire-wire and oda bad tins for di document wey dem write on February 10th.
Di Nigerians na Salih Yusuf Adamu, Babestan Oluwole Ademulero, Abu Abdullah ibn Umar Al-Barnawi, Abu Musab Al-Barnawi, Khaled (or Khalid) Al-Barnawi, Abu Bakr ibn Muhammad ibn Ali Al-Mainuki and Nnamdi Orson Benson.
Even di foma Kano State Govonor, Dr Rabiu Kwankwaso, Miyetti Allah Cattle Breeders Association of Nigeria, and Miyetti Allah Kautal Hore, US lawmakers don say make dem stamp visa ban and freeze dem hakant.
All di information dey for inside OFAC document, “Specifically Designated Nationals and Blocked Persons List,” but nor be only Nigeria name dey for inside.