+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

US Sojas Don Land Nigeria To Fight Terrorists

United States sojas don land Nigeria to join hand fight all di boko boys, ISIS and oda bad terrorist group wey dey disturb di kontri.

Na on February 3, 2026 nai General Dagvin Anderson, wey be head of U.S. Africa Command (AFRICOM), take anounce say small of US sojas don come Nigeria afta Washington and Abuja tok about how to scatter terrorists plans.

Even Nigeria Defence Minister, Christopher Musa, don still confam di mata but he nor put any salt and pepper to spicy how di parole go be. Di only tin be say na small nuba of US army nai enta no be plenty.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM