+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Vex As Nigeria No Karey Any Medal For 2024 Olympics

More than 80 pipo nai go 2024 Paris Olympics game but not wan fit bring any gold nor to tok of clay come back.

As di belle of Nigeria nor come dey sweet join, Minister of Sports and Development, John Enoh, on Sunday nai come dey beg make Nigeria nor vex again for how di Team dem behave.

He tok for X say dem go practice well for Paralympics wey dey road dey come cus dem don know where dem take fail as di team nor prepare well cus other kontris don start four years ago to prepare.

Even Peter Obi still say he dey vex for di Nigeria Team cus how kontri go use a whole N12 billion take put for 2024 Olympics and nor bodi come back with gold or clay.

Di LP candidate for 2023 election say, Jamaica wey use only 5% of di moni wey Nigeria spend kolet 6 medals for di game but Nigeria own with all di big moni leadership style nor make dem see clear road.

Nai he come dey sight di example of Favour Ofili, pesin wey sabi run, wey some officials remove she name from di game afta she don dey prepare for years for di game.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM