+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Wahala As Emirs Wan Pray For Di Same Mosque

Wahala still dey cook for Kano State as today Friday prayer be like e go get as e be cus nor bodi know who wan hold di Ju’mat prayers fo Emir mosque palace.

Bifor now, Danburan of Kano don bin send invitation on Thursday evening dey invite pipo to come hear di preaching of Malam Muhammadu Sanusi II di new Emir wey dem bring come back and say he go still folow dem pray.

But anoda paper dey wey still dey invite pipo to come folow Alhaji Aminu Ado Bayero pray around 12:30 for afternoon and na one of di Emir wey dem porchu aide nai send di invitation.

Pipo now dey confuse on wetin dey sup and dem dey fear make gbege nor go show cus even police pipo never tok on di mata.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM