+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We Dey Find Tuface o, Idibia Family Cry Out ‎

‎Innocent Idibia family don dey beg Nigerian pipo to epp find dem pikin as dem never see 2Baba for so e days now.

‎Tuface just lost like needle for bush since Monday 10th February and as di family don find am tire nai dem go tell Department of State Service, DSS, to epp dem, and e never too tay wey di mama come out dey beg Natasha Osaruwa to free her son from di jazz she take hold am.

‎Mrs Rose Idibia say di bead wey di Edo State lawmaker give her pikin 2baba na there di juju dey so make Nigerian pipo beg Natasha to remove di juju so that her son eye go clear.

‎For di letter wey dey waka online di family say dem don try all dem best to call do singer phone but he not dey ansa and dem nor fit find am.

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM