+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We Don Dey Sell Bag of Rice For N40k, Stop Protest — Information Minister

To make tins dey easy for pipo make dem mind komot from di August 1 to 10 days nationwide protest, Federal Govimet don say dem go sell bag of 50kg rice for 40,000 naira.

Na the Minister of Information Information and National Orientation, Mohammed Idris, nai tok say dem don send trucks of rice again to different parts of di state wet pipo fit buy for cheapaticle.

Na wey di Minister dey tok to state house correspondents, afta dem finish Federal Executive Meeting on Monday, nai he take say make pipo nor go protest again cus govimet get eye dey see nai make dem reduce di price of rice.

He say na di starting point be dis cus govimet still get Pipo for mind on how to make tins beta cus dem don do many investment for agriculture and very soon e go dey show.

Idris say right now di rice don reach different centers and e nor go pass N40k wey dem go sell am and dem nor still forget youths cus dem mata dey for president table.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM