Chairman of National Sports Commission (NSC), Shehu Dikko, don tell has Super Eagles players and officials say any moni problem dem go solve am bifor Saturday match.
Dikko say di moni wey dem budget for Super Eagles for di AfCON, na since November 2025 nai President Bola Tinubu approve am, just that e get different stages wey di moni dey pass, nai e cus di delay.
But di commissioner come say di Ministry of Finance and CBN dey make sure say di moni come out quickly, sl make di players nor fear.
Bifor oga Dikko come out to tok na cus Super Eagles don dey complain of dem moni and say if dem nor see am di game on Saturday wey dem wan go play for Marrakech against Algeria, dem go enta like dat worhout training and e go clear like cable TV.
