+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We Go Protect Who Wan Protest, But Bring Una Name — CP, Delta State

Di pipo wey dey behind di #EndbadGoverment nationwide protest wey dem wan do for August 1st, police don tell di pipo of Delta State to come out, submit details of wetin dem plan to do.

Na di Commisoner of Police for di state, CP Olufemi Abaniwonda nai say make di organizer join hand with police so that dem fit epp make tins easy, cus e nor go good say jaguda take over di process.

Wetin CP Abaniwonda tok say di organizers go give police na dem names, phone nuba, who be di group leader and di pipo wey organize am, join with di place wey dem go waka reach and gada.

Nai he still say make pipo nor fear as dem mind dey fully to see di peace of di protest for di whole state.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM