Di problem wey dey between Nigerian National Petroleum Company Limited and Leadership of Dangote Group of companies be like dem go soon end am afta all of dem sitdon yesterday do meeting.
Aliko Dangote wey be di CEO of Dangote Refinery just dey shout since say NNPCL dey frustrate hin life and don confam wetin he friend tell am say make he nor do investment for Nigeria.
To make sure say everybodi happy afta NMDPRA say Dangote Refinery nor get real licence and dem fuel na fake, Minister of State for Petroleum Resources, Heineken Lokpobiri, come gada oil sectors stakeholders join with Dangote make dem resolve di issue.
Na on Monday nai dem do di meeting for Abuja with Aliko Dangote, Chairman/CEO of Dangote Group, and Farouk Ahmed, the Nigerian Midstream and Downstream Petroleum Regulatory Authority CEO (NMDPRA), join with Gbenga Komolafe, Nigerian Upstream Petroleum Regulatory Commission chief executive and Mele Kyari, GCEO of Nigerian National Petroleum Company Limited with others.
Di Minister say di resin for di meeting na to find las las solution to all di quarel and even di stakeholders come say dem happy di way Lokpobiri take call dem.