+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We Go Stay East-West Road Till Di End, Niger Delta Youths

As pipo mind dey prepare for di August 1 protest to end bad govimet for di kontri di 21st Century Youths of Niger Delta and Agitators with Conscience (21st CYNDAC) don still dey beg pipo for South-South, South-East, and South-West make dem nor put bodi for di protest as na politicians dey behind am.

Bifor now, di Ovie of Idjerhe Kingdom, King Obukowho Whiskey, Udurhie 1, don still dey beg youths make dem nor protest and make Presido Bola Tinubu tok to youths about di pain for dem chest.

But as he dey like dis e don enta bodi cus di Niger Delta youths under di umbrella of Revamp Niger Delta Now Movement, RNDNM, say make nor bodi worry cus notin go stop dem make dem nor go for di protest from August 1st till August 10th.

Di youths say dem go block East West road, dey sleep chop there road until tins change and make all di politicians and traditional rulers just forget all those sweet mouth tok.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM