The Indigenous People of Biafra (IPOB) don talk say dem no get anything to do with Simon Ekpa supporters over the declaration of the United States of Biafra for Finland.
Ekpa say na him nia be d leader of the separatist group. After the Finish police arrest am den dem come send am go prison and den, some of Ekpa supporters come gather for Finland on Friday dey make the United States of Biafra declaration.
But for one statement on Sunday, Emma Powerful, IPOB otota say wetin Ekpa talk na scam.