+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We Nor Attack Any Protest Pesin For Abuja, Police

Police command for Abuja say make world pipo nor resin di video wey dey waka for social media say dem use tear gas chase October 1 pipo wey dey protest for FCT.

Di video show na na like 50 pesin wey dey protest near Utako market nai police enta use tear gas troway for dem.

But laslas di PPRO of FCT command, Josephine Adeh, say nor be true as na info dem get say some jaguda wan come tiff and scatter pipo store, so instead of dem to sitdon and nor do anytin nai dem take act sharply so make pipo nor resin di video.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM