+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We Nor Fit Kolet N48K as Minimum Wage, Labour

Way never pure between Labour, Federal Govimet and Organized Private Sector base on how much dem wan dey pay new minimum wage.

Na vex NLC and TUC Leaders take waka komot from  di meeting afta OPS say na N54k nai dem fit pay then FG say na N48k dem hand fit reach.

As di organized labour look up come down, nai dem say na just curse nai govimet dey give workers cus di N30k wey workers dey receive nor dey different from wetin dem tok now.

NLC and TUC tok say na big insult nai govimet troway for workers bodi cus even di Tripartite National Minimum Wage Committee report dey one side.

NLC president, Joe Ajaero and Deputy President of TUC, Dr Tommy Okon, as dem dey vex tok for Labour House nai say govimet nor serious with di kontri workers.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM