+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We Nor Give Extension To Kopa Wey Curse President Tinubu, NYSC

‎National Youth Service Corps (NYSC) don get anoda set of curse from pipo as di Rita Uguamaye wey dey serve for Lagos State say NYSC don give her extention to serve extra months bifor she pass out.

‎Rita na one lady wey dey serve for Lagos come come online dey curse President Bola Tinubu say he nor dey try as hunger wan kill pipo for his time, wey she post di video finish for TikTok naso mata come full ground.

‎Bifor pesin look, Rita say pipo don dey warn her to delete di video, why she go curse Lagos and President Tinubu, she come say na how e be, come tell Lagos pipo make dem nor vex.

‎But yesterday nai anoda video come say NYSC give her 60 days extension but di Acting Director of Press and Public Relations fod NYSC, Carol Embu say wetin Rita dey tok nai big lie.

‎Embu say di only pesin wey fit get extension for NYSC na di kopa wey don finish service year and nor be di one wey still dey serve.

‎She say Rita na still kopa wey dey do her NYSC and dem nor fit give her extention until as nor be so NYSC style be.

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM