+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We Nor See Any Bomb Arround Church As Abia Pastor Tok — Police

Some pipi for Aba, Abia State, still dey fear say bomb still dey around United Evangelical Church, Ehere/Umuola, for Ogbor Hill, afta di Associate Pastor, Eleazar Onyenweaku, det stand on say dem see bomb for front of di church and police don say nor be true.

Pastor Onyenweaku tok say wey dem dey dig di fence to komot di gate as govinet wan expand di road nai dem see di bomb for ground, he come karey pinsure go show army wey dey.for Ndoki Primary military base.

Di army karey Hilux to.go check and confam di bomb, take am from di place come say, oda ones fit dey around di place bit all dis wey di pastor dey yarn police say nothing like dat say di man nor be expert for bomb and nor even know wetin bomb be like.

For statement wey di Commissioner of Police for Abia State, Danlandi Isa thru di tokpesin of police for di state, Maureen Chinaka relase on Wednesday nite, say dem send bomb expert to di scene but notin like that cus di only tin wey one member of di church tell dem be say, na iron wey dem dig from di gate nai pastor Onyenweaku dey think say na bomb.

Even send, do anti bomb department for police don check and do examination for di place but no explosive dey there.

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM