+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We Wan Hear Wetin President Go Tok About Minimum Wage – NLC

With di plenty tok wey dey between NLC, Tripartite Committee and Federal Govimet concerning new minimum wage, pipo don dey fear say anoda strike go hapun.

But on Monday nai Joe Ajearo President of NLC, tok say organized Labour no go do strike today Tuesday, cus dem never hear from President Bola Tinubu.

Na for press conference nai Ajearo take say di tripartite committee nai come up with N62,000 and that one nor mean say dem go kolet am.

Know say Labour don reduce di N494k to N250k nai be di last price dem fit take cus even N100k nor go reach as minimum wage.

Comrade Ajearo say dem dey believe say President Tinubu go do di right tin, cus during Buhari time na 27k nai di committee karey go meet di president but Buhari come increase am to N30k, so make dem watch as dis film go play.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM