+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Weda Trump or Biden Win, Israel Must Pay For Attack On Gaza – Foma Aviation Minister

As United States of America dey prepare for dem president election for November dis year, foma Aviation Minister Femi Fani-Kayode, don say God go punish Israel if Donald Trump or Joe Biden win di election.

Fani-Kayode say e nor mata who win but Israel must know how e be for bodi cus of di way dem don deg attack Palestinians and Gaza for long.

Na for X nai di foma Minister take tok say e nor mata who win di US election weda na Trump or Biden, but you see Israel wey dey kparoma dem go hear am for all di evil wey dem don put for Gaza and Palestinians bodi.

He say na God go punish dem cus he nor dey sleep and go fight for pipo wey nor get power as karma go fall on Israel.

Know say Benjamin Netanyahu govimet don dey fight Hamas terrorist group for Gaza Strip and Palestine for more than eight months now.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM