Afta di gbasgbos wey pipo don use baff Daniel Bwala, di Presidential tokpesin on Policy Communication for President Bola Ahmed Tinubu, on Al Jazeera, he don say na di station nai do cut and join for di interview.
Bwala said Al Jazeera sitdon cut do inteview wey dem do for 1 hour 20 mins only upload like 40 sumtin mins online say na cus of di Iran and US wahala make dem nor first show am for TV as agreed.
According to Bwala everytin wey dem ask am for di interview he ansa all but na di way Al Jazeera take put am for social media, come turn am upside down as dem nor see di full video. He say make di station bring out di full video
