No be small tok nai follow First Lady, Senator Oluremi Tinubu, afta she go tell Govinor Ademola Adeleke for coronation anniversary of the Ooni of Ife, say make he tok quick and nor dey sing.
For di video, Govinor Adeleke dey sing worship song like who dey church and na di same event nai dem take crown First Lady as di Yeye Asiwaju Gbogbo IIe Oodua. Nai she waka tell am to stop do song and tok wetin he wan tok for 5mins or she go off microphone.
As pipo come dey blast First Lady nai she use picture wey she and Adeleke stand togeda say pipo just dey find tok for where tok nor dey.
