Family and friends of gospel singer and crew members wey die for one studio wey dey for Abraham Adesanya for Ajah, Lagos State, dom dey cry say dem nor go sitdon look say their children just die go like that.
Di pipo wey die so na Matthew Ogundele, Itunu Ogundele, Joseph Sanya, wey dey do blogger work, and Matthew Awosanya aka JoesTv. Dem find dem deadi bodi inside music studio afta di birthday party wey dem go sing for anoda gospel artist on Tuesday.
Di pesin wey organize di birthday na Olanireti Akinbola, but afta dem sing finish for nite cus say dem place far nai di 4 of di crew just sleep for di studio but di next morning, na deadi bodi full everywhere.
One of di pupo wey die mama, Matthew, don come out dey cry make pipo epp her cus how four pesin go just die like chicken.
Police say dem don karey di deadi bodi to mortuary and dem go do investigation to k ow werin really kill di crew.
