Couple wey bin plan dem wedding for April 5, 2025, don say dem nor do again cus of which church dem go dey go afta marriage.
Yakubu Azi Abok and Patience John Addra dem two na from Plateau State and di joh of dem big day start to sour afta di bride wey be strong Catholic say she nor go change church afta wedding.
Dem bin go dem last counseling class wey di Reverend come ask dem which church dem go attend togeda as husband and wife nai Patience wey be Catholic say she nor fit she church, di husband say lie lie na COCIN dem must attend togeda.
As Fada sew di way di two dey behave nai he ask weda dem neva settle di mata bifor but di groom come say he mama tell am say di wife must go he church with am or dem go scatter di marriage.
Tori say as di bride hear di mata nai she start to vex say weda na di mama wan decide for di groom, if naso make everybodi waka.
Oga groom reach haux download for he mama nai she say as Patience don tok am with her mouth make di marriage kukuma scatter bifor dem start am.
Bride see say mata serious, beg tire but di day of di wedding reach, pipo wear dress to go celebrate and eat with di couple but nor bodi show for church or reception ground.